Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nehemaya 11:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Dis na di ofisas wey kom stay Jerusalem. (Some of di pipol, Levi pipol, priests, temple savants and Solomon savants shidren-shidren still dey stay dia own house for di difren towns wey dey Judah,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nehemaya 11:3
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dis na di pipol wey from Babilon go back to Jerusalem and Judah. And each of dem go back to en town. Dia family dey Babilon since King Nebukadnezzar take dem go der as prisonas.


Di pipol wey dey work for di temple, wey kom back from Babilon, dia family na: Ziha, Hasufa, Tabbaot,


Di priests, Levi pipol and some of di pipol, di singas, di temple guards and di temple workers stay for di town wey dey near Jerusalem; while di remainin Israel pipol stay for di towns wey dia grand-grand papa stay before.


God priests, Levi pipol and di rest pipol for Israel dey stay where dia family land dey for Judah.


but some among di pipol for Judah and Benjamin go back to Jerusalem, na dem bi.) From Judah tribe: Uzzaya wey Zekaraya pikin Ataya born and na Amaraya born Zekaraya. Na Shefataya wey Perez pikin Mahalalel born, bi Amaraya papa.


Di priests family wey kom back from Babilon na: Jedaya (Jeshua shidren-shidren) family and dem bi 973;


Levi family wey kom back from Babilon na: Jeshua (Kadmiel wey Hodevah en papa, na en shidren-shidren) family and dem bi 74.


Di pipol wey dey work for di temple, dia family wey kom back from Babilon na: Ziha family, Hasufa family, Tabbaot family,


Dis na di pipol for di aria wey kom back from Babilon since King Nebukadnezzar karry dem go der as prisonas. Dem go back to dia towns for Jerusalem and Judah.


Di leaders wey kom back with dem na: Zerubabel, Jeshua, Nehemaya Nahamani, Zabud (Seraya), Reelaya, Mordekai, Bilshan, Mispar, Bigvai, Rehum and Baanah.


Di Priest, Levi pipol, doz wey dey guide di gate, doz wey dey sing, di temple savants and evry oda pesin for Israel kon stay for di town. So for di sevent monts, Israel pipol kon start to stay for dia towns.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ