15 From Levi tribe: Wi get Shemaya wey Hasshub born, wey Azrikam born, wey Hashabaya born, wey Bunni born.
Levi pipol wey kom back to Jerusalem na: Shemaya wey Hasshub born, wey Azrikam born, wey Hashabaya born wey kom from Merari tribe;
Kore wey Ebiasaf born, na-im pikin Shallum, with Korah pipol dey guide di door-mot for di tent where God present dey, just as dia grand-grand papa do before.
and 128 of en strong men follow am. Di pesin wey dey lead dem na Zabdiel wey Haggedolim born.
Wi still get Shabbetai wey Jozabad born, wey bi oga for di work wey dem dey do outside God Temple.