and Zabud wey bi di leader for God Temple. Na Hilkaya wey Meshullam born bi en papa. Zadok wey bi Meraiot pikin, na-im bi Meshullam papa. Meraiot na Ahitub pikin.
“Any matter wey koncern di king, una go ripot to Amaraya wey bi di shief priest and Ishmael pikin, Zebadaya wey dey lead Judah family. Levi pipol go bi una ofisas. Make una do una work well! Make God dey with doz wey dey do well!”
Jehiel, Azazaya, Nahat, Asahel, Jerimot, Jozabad, Eliel, Ismakaya, Mahat and Benaya dey work under Kenanaya and en broda Shimei wey bi di oga for God Temple, bikos na so King Hezekaya and Zabud wey bi oga for di temple, wont make e bi.
Wi still get 822 pipol wey dey work with am for di temple. Wi get Adaya wey Jeroham born, wey Pelalaya born, wey Amzi born, wey Zekaraya born, wey Pashhur born, wey Malkijah born
Naw, di pesin wey dey lead all di leaders for Levi tribe, na Eleazar wey Priest Aaron born. So dem choose am to supavise doz wey dey work for di Holy Place.