Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nehemaya 10:37 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

37 Di bread wey wi make from di first korn wey wi harvest for each year and oda ofrin like wine, olive oil and difren kind of fruits, wi go-go give dem to di priest for di temple. Wi go give Levi pipol one out of evry ten tins wey wi get from evritin wey wi plant for awa farm, bikos na dem dey kollect am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nehemaya 10:37
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Israel and Judah pipol wey dey stay Judah towns bring one from evry ten melu and sheep, with one from evry ten holy tins wey dem get, so dat dem go dey klean for God eye. Wetin dem bring plenty well-well.


I still hear sey, doz wey dey sing for di temple and some among Levi pipol don leave Jerusalem kon go back to dia farms, bikos di pipol nor dey give dem food.


Den Israel pipol kon start to dey bring one out of evry ten korn, wine and olive oil kom di temple store room again.


E build one big room where dem bin dey keep korn ofrins and incense, di tins wey dem dey use for di temple, di ofrin wey bi priests own and one from evry ten tins wey pipol bring from dia korn, wine and olive oil wey dem give Levi pipol and doz wey dey guide and sing for di temple.


I kon orda sey make dem do sakrifice take santify di room and make dem put di temple tins, korn ofrins and incense back for der.


una must give all di first-born wey bi man, both human being and animals to Oga God.


“Make yu dedikate all di first-born wey bi man for Israel give mi, weda na human being or animals.”


Each family go bring two bread and dem go offa dem give God as special gift. Dem go make each bread with two kilogram of flower; bake dem with yist kon offa am to God as ofrin from di first korn wey dem harvest.


“Make una bring one out of evry ten tins wey una get kom my temple, so dat food go dey der. Den make una try mi, weda I nor go open heaven kon pour many-many blessings for una head.


E dey good for pesin to shit God? No! But una dey shit mi and una dey ask, ‘How wi take dey shit Yu?’ Na for di matter wey koncern una ofrin and one out of evry ten tins wey una get.


Di first-born wey dem give to God, weda na human being or animal, go bi yor own. But di first-born for pipol and di first-born from man animal wey nor dey klean, dem must replace am.


But dia meat go bi yor own, just as di breast and di rite leg bi yor own.


“I don give Levi pipol all di tithes wey Israel pipol give mi. Dis na to pay dem for dia work wey bi to kare for di tent where dem for dey do meetin.


If dem give God di first part for bread, den na God get all di bread and if dem give God tree rut, den di whole tree don bi en own too.


Una must make sure sey una dey give God one from evry ten tin wey una get or harvest dat year.


Di first share for una harvest, new wine, olive oil and di wool wey una kollect wen una dey shear di sheep, make una give dem to di priest.


make una put some of di first fruits and plant wey una harvest inside one basket kon bring dem kom di place wey God don choose for woship and where dem go for honor en name.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ