Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nehemaya 10:36 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

36 Wi go karry di first boy pikin wey awa wife born go meet di priest for di temple and dem go dedikate am give God, just as dem rite am for di law. Wi go still dedikate di first melu, sheep, lamb and goat wey awa animals go born.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nehemaya 10:36
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen dem give di orda, Israel pipol bring dia grain, wine, olive oil, honey and all wetin dem get for dia farm. Dem bring one for evry ten tins wey dem get and dem plenty well-well.


Dat day, dem kon pick men wey go dey guide di store room for di ofrins, di first part for di harvest and one out of evry ten tin wey dem give God. Na dem dey kollect money from di field outside di town and di part wey di law give di priest and Levi pipol. All di pipol for Judah dey happy, bikos of di work wey Levi pipol and di priests dey do.


E build one big room where dem bin dey keep korn ofrins and incense, di tins wey dem dey use for di temple, di ofrin wey bi priests own and one from evry ten tins wey pipol bring from dia korn, wine and olive oil wey dem give Levi pipol and doz wey dey guide and sing for di temple.


“Make yu dedikate all di first-born wey bi man for Israel give mi, weda na human being or animals.”


“Una must bring di first fruit wey una harvest from una farm to di Oga una God house. “Make una nor kook yong goat wey still dey suck en mama breast.”


“Evry first-born wey bi man na my own; even di first pikin wey kattle, melu or sheep born.


“Make una bring one out of evry ten tins wey una get kom my temple, so dat food go dey der. Den make una try mi, weda I nor go open heaven kon pour many-many blessings for una head.


bikos all di first-born na my own. Wen I kill all di first-born for Egypt, I keep all di first pikin for Israel for mysef, so both man and animal na my own. Na mi bi Oga God.”


Di pesin wey dem dey tish God word, must share di good tins wey e get with di pesin wey dey tish am.


For der, una go karry burnt ofrin, sakrifice, vow ofrin, ordinary ofrin and una ofrin for di first fruit and animals wey una get.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ