Den wi kon go di temple for di fourt day, measure di gold, silva and di oda tins kon gi-am to Priest Meremot wey Uriaya born. Eleazar wey bi Finehas pikin and two Levi pipol; Jozabad wey Jeshua born and Noadaya wey Binnui born, dey der with am.
Afta, Levi pipol wey bi: Jeshua, Bani, Sherebaya, Jamin, Akkub, Shabbetai, Hodaya, Maaseaya, Kelita, Zabud, Jozabad, Hanan and Pelaaya kon esplain di law give di pipol wey stand der dey listin.