Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nahum 3:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Evribody wey si una go-go back kon sey, ‘Nineveh own don finish! Where dia pipol wey dey kill odas? Who dey kry sey dem distroy una?’ ”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nahum 3:7
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wahala don fall for una head; war don skata una land and una pipol dey hongry. E nor get anybody wey go sorry for una.


God sey, “Jerusalem pipol, who go sorry and pity for una? Who go stop kon ask, how una dey?


Bikos of dis, just as I ponish Assyria king, na so mi wey bi Israel God go ponish King Nebukadnezzar and en pipol.


Strenjas for der sey, ‘Wi bin won kom help Babilon town, but e don too late. Make wi leave am kon go back to awa house, bikos God don ponish Babilon pipol kon distroy di town.’ ”


Wetin I go fit tok? Who don ever si dis kind sofa before? Wetin I go fit take kompare yu, Jerusalem? How I go fit take konfort yu? Bikos di wound wey yu wound, deep like sea. Na who go fit heal yu?


Dis na di message wey God give Nahum wey kom from Elkosh town and na about Nineveh pipol.


I go skata di land for nort with my hand kon distroy Assyria land too. I go turn Nineveh, di main town to where dem dey trowey dirty put and e go bi desert.


Israel pipol wey dey der kon run komot wen dem hear di pipol dey kry. Dem kon dey shaut sey, “Make wi run o-o! Di eart fit swallow us too!”


Bikos di kings nor one join am sofa, dem go stand far dey sey, “E bad well-well! Babilon, di big town wey get pawa! E bad well-well for yu! Na for only one hour God take distroy yu finish!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ