Bikos of dis, I go bring all di pipol wey yu love togeda; di ones wey yu like and doz wey yu hate. Dem go round yu like circol, den I go tear yor klot komot yor body kon let dem si yor nakednes.
For Nineveh, God tok about Assyria pipol sey: “Una nor go get shidren wey go bear una name again. I go skata and distroy all di gods wey dey una temple and I dey prepare una grave, bikos una dey make mi vex!”
Instead make dem honor una, na disgrace go follow una and na una by unasef go drink kon stagga fall. God go make una drink from una own ponishment cup and una honor go turn to disgrace.
Dis na di find town wey dem guide well-well before. Di town bin dey boast sey, “Na mi great pass! E nor get any town wey bi like mi!” But naw, si as e don turn where dem dey trowey dirty put and na wild animals dey stay der naw. Evribody wey dey pass der, dey laf and shake dia head bikos of am.
Una must honor mi with wetin una dey do, but if una nor gri listin to wetin I dey tok, I go curse una. I go bikos of wetin una do, curse evritin wey una get. True-true, I don already curse una, bikos una nor gri honor mi.
Bikos e klear sey, di place wey God give us wey bi en apostles, na where worse pass for di world; wi bi like prisonas wey dem dey go kill. Angels and dis world pipol just dey take us make yeye.
Make una use Sodom and Gomorrah and di towns wey dey near dem, as ezample. God ponish dem with fire wey nor dey end, bikos both men and wimen dey sleep with each oda anyhow, dem even dey sleep with animals and dem dey do oda wiked tins wey dey dia mind.