19 Yor sore nor get cure and nobody go fit heal yu again. Doz wey hear as dem take distroy yu, dey klap and sing with joy, bikos yor wahala and trobol, too mush.
So make una listin! One news dey kom naw! Wahala dey kom from di nashons for nort! Dia sojas don skata and turn Judah town to desert where animals dey stay.
Pipol wey dey pass di town dey look una with shame. Dem dey laf and shake dia heads, bikos Jerusalem don skata. Dem sey, “Nor bi di fine town wey di world bin like well-well bi dis?”