Dem go distroy en horse and shariot. Sojas wey dem hire from oda land, go dey fear and dem go weak like woman. All dia betta-betta tins go skata and pipol go tif and karry di ones wey remain.
Babilon sojas don stop to fight and dem dey for dia tent. Dem nor get hope again and dem don weak like woman. Dem don break di town gate for groun kon burn all di house with fire.
Dem don disgrace and karry Nineveh pipol go anoda land. Dem don drag dia kween go. En girls savant dey mourn for am; dem dey kry like dove kon dey nak dia chest.
But know matter wetin una do, fire go still kill una; una enemies go kill una like lokust. Dem go kill evritin wey dem si and una nor go fit eskape, even if una plenty like many lokust.