Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nahum 3:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Yet, dem still karry en pipol go as slaves. Dem kill dia shidren for evriwhere for di street. Dem shain and divide Egypt sojas among demsef kon karry dem go as slave.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nahum 3:10
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Hazael kon ask am, “My oga, wetin make yu dey kry?” Elisha ansa, “Na bikos I know di kind trobol wey yu go kause for Israel pipol. Yu go burn dia propaty, kill dia yong men, distroy dia shidren and wimen wey get belle, yu go kut dia belle open.”


Yu go gambol for di pipol wey nor get papa again. Bikos of money, yu go sell yor friends wey like yu well-well.


Babilon pipol! God go soon distroy una. Di pesin wey go pay una back for wetin una don do to us, make happiness bi en own.


Di pesin wey go take una shidren dem take nak rock, make blessing follow am!


Dem tie dia enemies kings with shains and dia priests with iron


Dem go kill dia own shidren for dia front; dem go tif evritin for dia house and oda pipol go rape dia wifes for dia present.”


So make una kry with pain, bikos di day wen God go judge una don near; di day wen God wey get pawa won take distroy evritin.


I go give Egypt pipol to one bad ruler and na wiked kings go rule dem. Mi wey bi God wey dey lead heaven sojas, don tok.”


Assyria king go karry Egypt and Ethiopia pipol go as prisonas. Weda dem yong or old, dem go waka naked with ordinary leg and dia yansh go dey open and e go bi shame for Egypt pipol.


Wake-up for nite, make yu kry. Pour all yor heart like wota before God! Raiz yor hand as yu dey pray to am and dey beg for yor shidren wey dey faint, bikos honga won kill dem.


Make una si as gold nor dey yuzful again. Di gold wey fine and dey shine well-well before, nor dey shine again and di temple stones don skata for di street.


Dem whole yu with dia hand, but yu break kon skata dia hand; wen dem won rest on-top yu, yu break dia back and dem nor fit stand again.


I go ponish Samaria pipol, bikos dem nor gri listin to mi. Dem go die for war; dia shidren go fall kon skata and dia wimen wey get belle, dem go tear dia belle open with swod.”


Dem trow dice take divide who go take my pipol as slave. Dem sell boys and girls as slave kon use di money take buy wine and karry ashawo.


God sey, “Ammon pipol don too sin, but I go ponish dem naw, bikos dem dey fight to get more land and wimen wey get belle for Gilead, dem tear dia belle open.


Wen dia enemies dey attack dem, una stand dey look and nor gri help dem. Strenjas attack and karry all dia propaty kon trow dice take divide Jerusalem, but una bihave like sey Israel na una enemy.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ