Wen di year just start, King Nebukadnezzar kon give orda sey make dem bring am with di betta tins wey dey for God Temple kom Babilon. E make Zedekaya wey bi en family memba, king for en place for Jerusalem.
Pesin wey dey spoil pipol waka nor betta pass doz wey don die, bikos nobody spoil am. Di pesin wey dey deceive odas nor betta pass who don die, even doh nobody deceive am. Wen yu don spoil and deceive pipol finish, oda pipol go spoil and deceive yu too.
Una wey bi leaders and my pipol shepad, make una shaut kry well-well! Make una mourn and roll for san-san, bikos di time don rish wen dem go kill una kon kut una like goat
But God ask, “Na wetin I dey si so? Dem dey turn back, bikos of fear. Babilon sojas win dia sojas and dem kon run. Dem fear kon kwik-kwik run and dem nor even look back.
Una enemies go kollect una money with evritin wey una get. Dem go break una wall kon skata all di house wey una build with betta money. Dem go take di fine stones, wood, rubi and evritin, den kon trow dem inside sea.
Tins like gold, silva, stone wey dear, beads, fine linen, purpol klot, silk material, red klot and difren tins wey dem take wood wey dear, bronze, iron and marbol make.
Dem go sey, “E bad well-well! Babilon, di big town wey wear fine linen, purpol and red klot, plus gold, stone wey dear and beads! E bad well-well for yu!