6 Dem don skata and open di river gate! Di palis go soon fall!
Di king shaut koll en ofisas; dem dey run fall as dem dey rush go guide di town.
Dem don disgrace and karry Nineveh pipol go anoda land. Dem don drag dia kween go. En girls savant dey mourn for am; dem dey kry like dove kon dey nak dia chest.
Una sojas weak like woman wey nor get who to help am. Dem go open una town gate for una enemies and dem go put fire kon burn am rish groun.