Dem don arrange di party tabol; put rug for groun where pipol wey dem invite go sidan put. But as dem dey chop and drink, dem kon hear di kommand, “Una wey bi sojas, make una prepare for war!”
Tell di sojas make dem attack Babilon. Make evribody wey sabi shot bow, surround di town so dat nobody go eskape. Una must pay dem back kon trit dem, just as dem trit odas, bikos dem dey karry body for mi wey bi di Holy One for Israel.
Dem dey ready to kill. Dia swod and spear dey shine as dem dey kill pipol for evriwhere. Nobody fit kount di pipol wey dem kill and doz wey remain dey run fall on-top di dead body dem.