Yu know sey, David yor papa and en men strong well-well for fight, like bear for bush wey dey find en pikin. Yor papa na soja wey get sense and e nor dey stay with en men for nite.
King Nebukadnezzar for Babilon don skata, chop and distroy my town like empty cup. E swallow am like wiked animal and na awa propaty full en belle. E still porshu us komot from awa own land.
So wetin don happen to Nineveh, dat great town? Dat place where lion full? Just as lion and en shidren nor dey fear to waka, na so too di pipol for der nor dey fear to waka before.
But Oga God wey dey lead Heaven Sojas sey, “Nineveh pipol, I bi una enemy! I go burn una shariot kon kill una yong men for war. Evritin wey una take from oda nashons, I go take dem from una hand and nobody go hear una messenjas vois again.”