Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Nahum 2:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 So wetin don happen to Nineveh, dat great town? Dat place where lion full? Just as lion and en shidren nor dey fear to waka, na so too di pipol for der nor dey fear to waka before.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Nahum 2:11
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Judah my pikin, yu bi yong lion wey just chop wetin e kill finish. Yu dey kill like lion kon kwayet dey look; yu bi like woman lion, na who go fit fight am?


So bikos of dis, evry hand go weak and evribody heart go fail am.


True-true, dis na wetin God tell mi, “Like lion wey dey shaut with vexnashon or yong lion wey won chop wetin e kill, na so I go bi like. Even doh many shepad gada round di lion, e nor dey fear dia shaut or run from dem. Na like dis too, Oga God wey dey lead heaven sojas, go kom help Mount Zion.


Di sojas dey shaut like lion wey kill animal kon karry am go where nobody go for fit take am from am.


Di enemies dey shaut like lion as dem dey distroy my pipol; skata dia land and burn di towns with doz wey dey stay der.


Just like lion wey kom out from where e hide put, na so too di pesin wey dey distroy nashons go kom out. E dey kom distroy Judah: di town go skata finish and nobody go stay der again.”


God sey, “Israel pipol bi like sheep wey run skata for evriwhere bikos lion dey porshu dem. Assyria king first attack and kill dem, before King Nebukadnezzar for Babilon kon break dia bones.


Like lion wey kom out from bush near Jordan, na so too, mi wey bi God go kom attack and porshu Babilon pipol komot from dia town. Den di leaders wey I choose go rule di nashon. Bikos nobody bi like mi and who go fit shalenge mi? Wish ruler fit follow mi make mout?


“Man pikin, go warn Egypt king. Tell am dis message wey I dey give yu: “ ‘Yu bi lion among di nashons, but na ordinary animal yu bi for sea; Yu dey skata di wota with yor leg kon make di river dirty.


Evribody dey fear and kry as dem si dem dey kom.


Dem go rule Assyria with dia swod kon enter Nimrod land. E go save us from Assyria pipol wen dem kom attack us.


Di lion dey kill wetin e katch kon tear dem to pieces for en wife and shidren. Na flesh full di lion house.


Curse dey di town wey full with innocent pipol blood! Na lie-lie and propaty wey dem tif, naim full der and na to kill pipol bi dia work.


En leaders bi like hongry lion wey dey look for who dem go chop. Dem dey hongry like wolf for desert wey dey chop dia food finish for morning.


Israel pipol go bi like strong lion wey nor dey rest until e don distroy en enemies kon drink di blood of di pesin wey e kill.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ