Wen dat time rish, I go free una from Assyria pipol pawa and dem nor go bi load for una shoulder again. I go free una, bikos dia load go too dey heavy for una to karry.”
I go distroy Assyria pipol for my land. I go skata dem put under my hill. I go free my pipol and remove di load wey Assyria pipol put for dia shoulder.
All dis joy na bikos Yu don remove dia heavy load and di kane wey dem take dey flog dem. Yu don defeat di pipol wey dey tif and opress oda pipol, just as Yu bin defeat Midian sojas.
“E don tey wen una rijet my kommand or obey and woship mi. Instead, una give unasef to all di gods wey dey di hill and under evry green tree, like sey una bi ashawo wey dey find who e go sleep with.
I go-go meet and tok to di leaders, bikos dem know wetin God wont and wetin E sey make dem do.” But even dem too don rijet God and nor gri obey en kommand.
Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt, so dat una nor go bi slave again. I skata di pawa wey hold una for groun and I make una waka with pride.”