6 Bikos boy pikin go rijet en papa and na so too girl pikin go rijet en mama. Wife go sey e nor know en husband mama and una enemy, go bi una family memba!
David tell Abishai and all en ofisas, “My own pikin one kill mi, so why una dey sopraiz for dis man wey kom from Benjamin tribe? Na God tell am make e curse mi, so make una leave am make e dey curse.
Dem go dey fight each oda; Men go oppoz each oda and neighbours go fight against dia neighbour. Yong pipol nor go respet dia senior and foolish pipol go dey curse doz wey dem bin dey respet.”
I hear as pipol dey gossip mi. Dem dey koll mi, “Di Man Wey Fear One Kill.” Dem dey treaten sey, “If yu tok anytin here, wi go ripot yu.” Even my friends before, dey look and dey wait make I fall. Dem dey sey, “E go fall enter di trap, den wi go know sey wi don revensh am back.”
Make evribody dey kareful of en friends and make yu nor trust yor broda, bikos even broda dey shit en broda. And friends dey lie against each oda well-well.
Nobody for di town dey respet dia papa or mama again. Una dey shit strenjas; wimen wey dia husband don die and shidren wey nor get papa and mama again.
Doz wey dey help una go turn against una. Dem go help una enemies porshu una komot from una land. Even doh dem dey plan to deceive and distroy una, dem go promise una peace. Una friends wey una trust pass, go set trap for una and una nor go even know.
Papa go dey against en son and son go dey against en papa, mama go dey against en dota and dota go dey against en mama, husband mama go dey against en pikin wife and wife go dey against en husband mama.”
“Wetin I dey tok so nor koncern all of una, bikos I know di pipol wey I choose. Dis show sey God word na true sey, ‘Di pesin wey follow mi chop don turn to my enemy.’