Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mikah 7:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Pipol go from difren land kom honor una; dem go kom from Assyria go rish Egypt town; from Egypt to Eufrates River and from di far sea go di mountins.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mikah 7:12
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.


E go kreate one way wey en pipol wey remain go take komot for Assyria land, just as e happen for Israel pipol wen dem dey komot from Egypt.


I go tell di nort make dem let dem go and di sout nor go hold dem for der. Make my pipol kom from evriwhere for di world.


Si, my pipol go kom from far; some from nort, west and from Egypt wey dey sout.”


I go gada my pipol wey remain from di kountry where I skata dem put kon bring dem kom back to dia land. Dem go get many shidren kon prosper for evritin and for evry side.


For dat time, Israel pipol go join Judah pipol kom back from di land wey dey nort and dem go kom back to di land wey I give dia grand-grand papa as dia own propaty.”


Den I ansa, ‘I go bring dem back from nort kon gada dem from evry part for di eart. Doz wey blind; wey nor fit waka; wimen wey get belle and doz wey won born, go follow dem kom back too. Dem go kom back as one great nashon.


“So make my pipol, Israel nor fear! Make una heart nor shake. I go save una from dat land wey far wey una for bi prisonas. Una go kom back to una land kon stay for peace. Una go dey save and nobody go make una fear again.


“Wen dis tins happen, I go make Israel pipol strong and yu, Ezekiel, go tok for where evribody go hear yu, so dat dem go know sey na mi bi God.”


Den make yu tell dem sey, ‘God wey get pawa go-go bring all en pipol for evriwhere wey dem skata go. E go bring dem kom back to dia own land.


Dem go rush kom from Egypt like bird and from Assyria like dove. I go bring dem kom back to dia town again. Mi, wey bi God, don tok.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ