Na only few pipol go survive for Israel and e go bi like olive tree wey dem plok all en fruit komot kon leave like two or three fruit for en branches. Mi, wey bi Israel God, don tok.”
Dis na wetin go happen for evriwhere for di world. E go bi like wen dem dey plok olive tree fruit for harvest time kon leave only di small-small wons for der.
Pipol go dey sing for evriwhere for di world as dem dey praiz Israel pipol God wey dey raitious. But I nor get hope at-all and na die I dey die go so, bikos pipol wey dey lie, still dey lie and doz wey dey deceive odas, still dey deceive!
I kon sey, “My own don finish, bikos evry word wey dey komot from my mout, na sin full am and I dey stay with pipol wey all dia words na sin and naw, I don use my eyes si Oga God wey bi di king wey get pawa.”
I kon sey, “Si as I dey vex! Wetin make my mama born mi at-all? Must I kworel and argue with evribody for di land! I neva ever borrow from pesin or borrow pesin money, yet evribody dey curse mi.”
I hear kry, like woman wey won born; shaut like woman wey dey born en first pikin. Jerusalem pipol dey find as dem go take breath and naw, dem dey kry sey, “Make una help us! Bikos na die wi dey so o-o!”
God sey, “Waka round Jerusalem street kon shek for where pipol gada weda una go si any good and raitious pesin. If una si, I nor go ponish di town again.
God sey, “Wen I first si Israel, e bi like wen yu si grape wey dey grow for desert. Wen I first si una grand-grand papa dem, e bi like wen yu first si ripe fig for en sizin. But dem go meet Baal for Peor kon dey woship am and dem kon bi like di juju wey dem love.