Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mikah 6:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Di rish pipol among una dey get more money thru wayo and wikedness. Una pipol don too good with lie and trut nor dey dia tongue again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mikah 6:12
29 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

My God, make Yu save mi from pipol wey dey lie and deceive odas.


Dem nor dey tok about peace. Dem dey plan against innocent pipol wey dey mind dia business.


But dem dey lie give God kon dey tok anyhow.


Una leaders don rijet mi and na tif bi dia friends; dem dey always kollect bribe from pipol. If pipol wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die bring dia kase kom meet una, una nor dey defend or listin to dem.


Yes! Jerusalem pipol own don finish and Judah town don dey fall! Evritin wey dem dey tok and do, dey make God vex, bikos dem dey oppoz God law.


Na Israel pipol bi God vineyard, why Judah pipol na di good vine wey E plant. E espect dem to do good, instead dem dey do bad and kill pipol. E bin dey wait to si weda dem go do wetin dey rite, instead pipol wey dem kill, dia blood dey kry go meet God.


Dia mout sharp like arrow and na so-so lie full am. Dem dey tok well with dia neighbours, but for dia mind, na trap dem dey set for di pesin.


“Wen ever I sey I won heal and make my pipol, Israel prosper again, dia wikedness and di bad-bad tins wey dem dey do, nor dey allow mi do am. Samaria pipol dey shit each oda and dey do bad tins. Dem dey break enter pipol house and dey tif waka for street.


Dia own don finish! Dem don forget mi kon dey do wetin I sey make dem nor do, so I go distroy dem. I won save dem before, but dem nor dey woship mi from dia heart.


God sey, “Bikos Judah pipol don too sin, I go ponish dem naw. Dem hate wetin I tish dem and nor gri obey my kommand. Di same lie-lie gods wey dia grand-grand papa dem serve, don deceive dem too.


E go bad well-well for una wey dey relax for una big fine chair kon dey chop betta meat!


For dat day, I go ponish di pipol wey dey serve juju and wey turn dia oga house to where dem dey kworel and play pipol wayo.”


En leaders bi like hongry lion wey dey look for who dem go chop. Dem dey hongry like wolf for desert wey dey chop dia food finish for morning.


As e dey tok, di Jew pipol too dey support sey, wetin e tok, na true.


Na lie wey fit kill pesin full dia mout and wiked words full dia tongue.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ