11 How I won take bilive una wey dey sell and measure with wayo cup?
God hate pipol wey dey play wayo, but E dey love doz wey dey do good tins.
Make una nor dey play wayo wen una dey measure and sell tins give pipol, bikos God nor like am.
God hate pipol wey dey weigh and measure tins with wayo.
Evribody must measure well So from naw go, make evribody dey measure well.
But Israel pipol nor dey tok true; dem bi like Kanaan pipol wey dey shit and play dia customers wayo.
Make una dey measure well for evritin wey una dey do. Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt.
Una dey tell unasef sey, “Wen di new moon festival go end sef, so dat wi go fit go sell awa korn? Na wen Sabat go end, make wi for fit sell again? Wi nor fit wait to shit awa customers, use wayo take measure tins, so dat wi go get more money.
Den di angel sey, “Dis woman name na, ‘Wikedness.’ ” So e push di woman enter di basket back kon kover am.
Wen una dey measure tins, una must measure well