Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mikah 5:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Jerusalem pipol, make una gada unasef like sojas, bikos enemies dey hide won kon attack una. Dem go use rod take nak Israel leaders face.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mikah 5:1
35 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Rashel die and dem beri am for di road wey dem dey pass go Efrat (wey bi Betlehem naw).


Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.


Den Profet Zedekaya wey bi Kenaana pikin, waka kom meet and slap Mikaya, den e ask am, “Since wen God Spirit leave mi kon dey tok to yu?”


God kon send Babilon, Siria, Moab and Ammon sojas against am; God send dem go distroy Judah, as E bin warn dem thru en profets.


Pipol dey curse and laf mi. Dem dey slap mi for face and dem don gada against mi.


God kreate mi before di world start. Na mi E first give life to.


I send Assyria pipol go attack di nashons wey nor know mi kon karry, tif and skata di pipol like dirty for street.


Bikos God wey bi awa ruler, kommander and king, go diliver us.


Dem go distroy di town kon skata evriwhere! So make una listin, all di far-far land for di eart. Make una dey ready to fight, but dem go still distroy una!


True-true, dem go burn di boot wey di sojas take fight and dia klot wey blood stain.


‘I go koll di pipol wey dey nort and my savant King Nebukadnezzar for Babilon and dem go kom fight against Judah pipol and di towns wey dey round Jerusalem. I go distroy and skata dis nashon and di ones wey dey round am, forever. I go make pipol si and dey fear dem.


Just like lion wey kom out from where e hide put, na so too di pesin wey dey distroy nashons go kom out. E dey kom distroy Judah: di town go skata finish and nobody go stay der again.”


Pesin wey dem slap for one side, make e turn di oda side. Make e nor tok wen en enemies dey curse am.


Dem go distroy una with fire. Una blood go flow for una own kountry and nobody go remember una again.’ ” God wey get pawa don tok.


“Man pikin, make yu rite today date for groun, bikos Babilon king go seize Jerusalem.


“So make yu know and undastand sey, ‘From naw wen I tell yu dis message, till di time wen dem go ribuild Jerusalem and di leader wey God choose go kom, e go bi seven weeks and sixty-two weeks. Dem go build di town well again, but wahala go dey for dat time.


So make una tell pipol for difren kountry sey: “Make una ready for war and koll all una strong-strong men, den gada dem go fight!


I go kill all dia rulers and leaders.” Dis na wetin Oga God tok.


I won give Babilon pipol pawa; doz wiked pipol wey nor dey sorry for odas. Dem go mash round di world kon seize all di oda nashons.


I fear well-well wen I hear all dis tins and my lips kon dey shake. Fear and kold katch mi at wons. I go really wait for di time wen God go ponish doz wey dey attack us.


Dem kon spit for en face, beat am and some slap am,


Dem spit for en body kon take walkin stik nak en head many times.


But I tell una, make una nor fight, if anybody slap yor face, turn di oda side gi-am too.


Afta Jesus don tok finish, one of di High Priest savant, wey stand near am slap am for face kon ask am, “Na di High Priest yu dey tok to like dis?”


Dem kon dey laf am, dey take am make yeye, dey sey, “Make una kon si di Jew pipol king.” Dem slap am for face many times.


Bikos of wetin e tok, Ananias wey bi di High Priest kon orda di pipol wey stand near Paul sey make dem slap am for mout.


Una like make pesin turn una to slave; use and shit una; take evritin wey una get, den beat and slap una anyhow.


God go bring some pipol from far against una and dem go kill una like vulture. And dem bi pipol wey una nor go undastand wetin dem dey tok;


Na di God wey go dey forever bi una guide and provida. En hand wey go dey forever, dey support una. E drive all una enemies kon sey make una distroy dem!


One day, one Levi man wey dey stay Betlehem for Judah kon kom di aria.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ