Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Mikah 3:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 So, na only darkness una go dey si and una nor go get any vishon. Darkness go kover una kon end evry hope wey una get. Sun nor go shine for una profets head again a nd una life go end like dat.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Mikah 3:6
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Naw, wi nor dey si yor mirakles again. All di profets don die and nobody fit tell us wen dis wahala go end.


God don make una dey do like sey una don drink, so una go sleep go. God don blind di profets eyes and doz wey dey sey future nor go fit si anytin again.


and wi dey waka anyhow like blind pipol. Wi dey fall for aftanoon and for nite; e bi like sey wi dey dark world, for where dead pipol dey.


Make una respet di Oga una God, before E go bring darkness wey go make una kick stone fall on-top mountins! Make una respet am, before E go turn una lite to darkness.


Di woman wey bin get seven shidren, go faint. E nor go fit breath well again. Naw wey e suppose to dey enjoy life, dem don take en pride and joy from am. E go bi like sey evening don rish even doh sun still dey shine well-well. Na shame and disgrace go follow am. And any of dem wey still dey alive, I go make dia enemies kill dem for war.” Mi, wey bi God, don tok.


Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”


I go soon ponish una wey bi lie-lie profets, bikos wetin una dey tok, dey skata pipol. Una nor go dey der wen my pipol go gada make decision; una name nor go dey among Israel pipol and una nor go ever kom back to di land. Den una go know sey na mi bi God.


One diziz go follow anoda and na so-so bad-bad news una go dey hear. Una go beg di profets make dem tell una wetin dem si. Di priest nor go get anytin to tish di pipol and una eldas nor go fit give betta advise.


Di time dey kom wen I go send honga kom di land. Pipol go dey hongry, but nor bi for food. Dem go dey thirsty, but nor bi bikos of wota; instead dem go dey hongry to hear God message.” Oga God don tok.


But di pipol tell mi, “Make yu nor tok like dat. Nor prish like dat, bikos dat kind wahala nor go ever happen to us!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ