Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 9:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon ask dem, “Wetin make una dey tink dis kind bad tin for una mind?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 9:4
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu know wen I sidan or wen I stand up. Yu know wetin I dey tink even wen I dey far from Yu.


E go know, bikos E know wetin dey evribody mind.


Dis na wetin God wey get pawa dey tell Gog: “Wen dat time don rish, yu go start to tink of di wiked tins wey yu go do.


Wen Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, e kon sey, “Evry kingdom wey dey fight with ensef go skata and know town or family wey dey fight demsef, go fit stand.


But Jesus know dia wayo, so e tell dem, “Why una dey test mi? Make una bring one koin make I si.”


At wons, Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, so e kon ask dem, “Why una dey tink like dis?


Jesus know wetin dey dia mind, so e tell dem, “Any kingdom where pipol dey fight each oda nor go last and family wey divide, go fall.


Jesus know wetin dem dey tink, so e ask dem, “Why una dey tink like dis sef?


But Jesus know wetin dem dey tink, so e kon tell di man wey en hand die, “Get up, make yu kom stand for here”, so di man get up, go stand near am.


Jesus kon tell di Farisee, “Simon, e get wetin I won tell yu.” Simon kon sey, “Tisha, I dey listin.”


Jesus si sey dem won ask am about wetin e tell dem, naim e ask dem, “Una dey ask each oda wetin I mean wen I sey, ‘Time go soon kom wen una nor go si mi, but afta sometaim, una go si mi?’


Naw wi know sey yu know evritin and yu nor nid anybody to ask yu any kweshon. Bikos of dis, wi bilive sey na God send yu kom.”


Jesus ask am di third time, “Simon, John pikin, yu sure sey yu love mi so?” Pita kon dey vex, bikos e pain am well-well, as Jesus ask am di same kweshon three times, “Yu sure sey yu love mi so?” Den Pita sey, “Oga God, yu know evritin, yu know sey I really love yu.” So, Jesus tell am, “Make yu feed my sheep.


Wen Jesus know sey en disciples dey komplain about wetin e tok, e kon ask dem, “Wetin I tok so dey make una vex too?


But some of una nor bilive.” (From biginnin, Jesus don know di pipol wey nor go bilive and di pesin wey go sell am give en enemy.)


So Pita tell am, “Wetin make yu and yor husband decide to try God Spirit like dis? Look! Na di pipol wey go beri yor husband dey kom so and dem go karry yu go beri too!”


I go kill all en shidren, den all di church pipol go know sey, I know wetin dey for pipol mind and heart. I go reward evribody akordin to wetin e do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ