3 Den some law tishas kon dey tok to demsef sey, “Si as dis man dey shalenge God.”
and pesin wey use God name anyhow, must die. Israel pipol go stone am weda na strenja e bi or not; anybody wey use God name anyhow, go must die.
“ ‘But anybody wey kommit sin with en mind, weda dem born am for Israel or na strenja, dat pesin don curse God and dem must kill-am,
Den di High Priest tear en klot kon sey, “E don tok against God! Why wi still nid anoda witness? Una don hear as e tok against God!
bikos e tish dem like pesin wey get authority and nor bi as dia law tishas dey do.
Una don hear di word wey e tok against God! Wetin una tink sey make wi do am?” Dem kon ansa, “E suppose to die.”
I tell una true word, God go forgive pipol di sins wey dem kommit and all di bad word wey dem tok.
But anybody wey tok bad word against di Holy Spirit, God nor go ever forgi-am, bikos e don kommit sin wey go last forever.”
Bikos to sleep with who yu nor marry, to tif, to kill pesin,
So di law tishas and di Farisee pipol kon dey tell diasef sey, “Who bi dis man wey dey shalenge God like dis? Who fit forgive sin escept God?”