Some pipol kon bring one man wey nor fit waka kom meet am. Wen Jesus si as dia faith strong rish, e kon tell di man wey nor fit waka, “My pikin, make yu nor fear! God don forgive yu all yor sins.”
Bikos of wetin dem tok, di pikin papa kon remember sey dat na di time wen Jesus tell am sey, “Yor pikin nor go die.” Bikos of dis, di man and evribody wey dey en house kon bilive Jesus.
E kontinue to dey shaut like dis for many days. So di tin vex Paul well-well, naim e turn face di girl kon tell di spirit, “I kommand yu with Jesus Christ name, komot for dis girl body!” At wons, di spirit komot from di girl body.