19 So Jesus and en disciples kon follow am.
Jesus kon ansa, “I go kom heal am.”
As Jesus dey tok dis tins, one oga kom knee down for en front sey, “My dota just die, make yu kom tosh am and e go wake-up.”
One woman wey blood dey rush komot for en body for twelf years kon kom Jesus back, den e tosh en klot korna.
Jesus kon tell dem, “My food na to do wetin my Papa tok and make I finish di work wey E send mi.
Jesus Christ wey kom from Nazaret, na-im God give di Holy Spirit and pawa. Una still know how e do good for evriwhere kon heal pipol wey devil dey opress, bikos God dey with am.