Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 9:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Jesus ansa, “Pipol wey kom marriage nor fit mourn if di man wey dey marry dey with dem! Abi e dey happen like dat? But di day go kom wen dem go take di man wey dey marry komot from where dem dey, dat time, dem go fast.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 9:15
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For dat time, Oga God wey dey lead heaven sojas kon sey make una dey kry, mourn, shave una hair and wear sak klot.


John disciples kom meet Jesus kon ask am, “Why e bi sey wi and di Farisee pipol dey fast evritime and yor disciples nor dey fast?”


“Nobody dey take new klot pash di whole wey dey for old klot, bikos where dem pash for di old klot go tear more and di whole wey go dey der, go big pass di one wey dey before.


Jesus ansa dem, “Pipol wey kom marriage nor fit fast wen di man wey dey marry dey with dem, abi dem suppose to? So-far di man wey dey marry dey with dem, dem nor nid to fast.


But di time dey kom wen dem go take di man wey dey marry from dem, by dat time, dem go fast.


Den Jesus tell en disciples, “Di time dey kom wen una go won si Man Pikin, but una nor go si am.


So Jesus ansa dem, “Yu go fit sey make pipol wey kom marriage dey fast wen di man wey dey marry dey der?


But time dey kom wen di man wey dey marry nor go dey with dem, dat time, dem go fast.”


But una nor happy as I dey tell una all dis tins.


Di pesin wey won marry new wife naim bi di bridegroom. En friend, wey bi di best man, dey listin to am. E go dey happy well-well wen e hear di bridegroom dey tok. Na dis dey make mi happy and my joy don full.


Wen dem don choose eldas wey go lead di bilivers for di difren-difren church, dem kon pray and fast sey, make God protet dem.


Make una nor refuse each oda, escept una gri sey una go dey like dat for sometaim, so dat una go fit pray. Den Satan nor go fit tempt una, bikos una go fit kontrol una body.


I don do hard work; nor sleep for many nites; food and wota go dey hongry mi; many times, I nor get food to chop. I don dey for kold and I nor get klot to kover body.


Den di angel tell mi, “Rite dis tin wey I won tok naw: ‘God don bless pipol wey en invite kom chop for di Lamb marriage!’ ” E still tell mi sey, “Dis na God true word.”


And I si di holy town, di new Jerusalem, dey kom down from heaven from God and dem dress am like woman wey won go meet en husband.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ