Dem dey tell odas sey, “Make una nor near us, wi dey too holy for una to tosh! Doz pipol bi like smoke for my nose, bikos my vexnashon for dem bi like fire wey nor dey kwensh.
But wen Man Pikin kom, e chop and drink and una sey, ‘Si am, long-trot, drunkaman, tax kollectors and sinnas friend!’ But God wisdom dey show for wetin e dey do.”
Wen di law tishas and di Farisee pipol si sey e dey chop with sinnas and tax kollectors, dem kon ask en disciples, “Why una oga dey chop with tax kollectors and sinnas?”