33 Di pipol wey dey look di pigs, run go di town kon tell pipol evritin wey happen to di men wey get demons.
So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem.
Wen evening rish, dem karry many pipol wey demon dey inside dem kom meet Jesus. E drive di wiked spirits komot kon heal all di pipol wey nor well.
So Jesus tell dem, “Make una go!” At wons, dem kon komot enter inside di pigs and all di pigs rush go enter di river kon die.