Even birds get house for der and sparo bird still build dia nest for where dem go fit protet dia shidren near yor altar. My Oga wey dey rule ova evritin, my king and my God.
As I still dey look for di vishon for nite, I si wetin bi like human being. E dey waka kom with kloud wey dey round am, den e go show ensef give di Pesin wey dey live forever.
Anybody wey tok bad against Man Pikin, God go forgi-am. But anybody wey tok bad against di Holy Spirit, God nor go ever forgi-am, weda for dis life or di one wey dey kom.”
Jesus ansa am, “I tell yu true word, for dat time wen evritin go dey new, Man Pikin go sidan for en throne wey get glory and una wey dey follow mi, go sidan for twelf thrones, dey judge di twelf tribes wey dey Israel.
If anybody shame for mi and wetin I dey tish for dis world wey wiked and ashawo pipol dey, Man Pikin go shame for am too, wen e go kom back for en Papa and en holy angels glory.”
But make una dey shine una eye evritime, dey pray make God give una pawa take pass all dis test wey go happen, so dat una go fit stand for Man Pikin front.”
Den di pipol ask, “Wi know sey God law sey, ‘Christ go live forever.’ Why yu kon dey tok sey dem go karry Man Pikin put for cross? Na who bi dis Man Pikin sef?”
Make una nor work for food wey nor dey last, but for food wey go give una life wey nor dey end and dat kind food, na only Man Pikin go fit give una, bikos na-im God send kom.”