17 Dis one make wetin Profet Isaya tok bi true, “E remove awa sickness and karry awa diziz komot.”
Abraham take di wood for di ofrin kon karry am put for en pikin Isaak head. Den e take di fire and di knife and di two of dem kon waka dey go.
But E bear di sofa and pain wey suppose bi awa own. But wi tink sey en sofa na di ponishment wey God gi-am.
Dis tins go happen as God profet tok:
Dem stay der till Herod die. Dis tin make wetin God profet tok happen sey, “I koll my pikin komot from Egypt.”
Wen e rish Nazaret, e kon stay der. Dis one make wetin Profet Jeremaya tok happen sey, “Dem go sey Jesus, na Nazaret e from kom.”
Wen sun don dey go down for evening, dem kon bring all di pipol wey nor well and wey get demon kom meet Jesus.
As day dey dark, evribody wey get pipol wey nor well kon bring dem kom meet Jesus. E tosh dem for head and dem kon well.
I dey happy as I dey weak with all di curse, trobols, ponishment and wahala wey I dey sofa bikos of Christ, bikos anytime wey I dey weak, na dat time, I dey-dey strong.
E karry awa sin for cross, so dat wi go stop to sin and dey do good for God eye. “Na di wound wey dem wound am, naim make us well.”