Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 8:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 But dem go trow di pipol wey suppose enter di Kingdom for darkness, where dem go dey kry and grind dia tit.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 8:12
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen wiked pipol si dis tins, dem go dey fear and worry; dem go grind dia tit dey vex; dem go melt trowey and evritin wey dem wont, go distroy.


My pipol go sing dey happy, but doz wey nor dey obey mi, go kry with pain.


di farm na di world and di good seed na di kingdom pipol. Di grass na devil shidren


Dem go trow dem inside fire wey nor dey kwensh, where dem go kry and grind dia tit.


and dem go trow evil pipol inside hell-fire, where dem go kry and grind dia tit.”


“Na dis make mi tell una sey, ‘Dem go take God Kingdom from una and dem go gi-am to pipol wey go bear di kind fruit wey E wont.’


e go kut di savant to pieces kon trow am put for where pritendas dey, where e go dey kry and grind en tit.”


Make una trow dat wiked savant inside darkness for outside, where e go kry and grind en tit.’


“Una go kry dey grind tit wen una si Abraham, Isaak, Jakob and all di profets inside God Kingdom, but God go trow una for outside.


All of una get share for inside di promise wey God make with una grand-grand papa dem thru di profets. Na so E tell Abraham sey, ‘Na thru di pikin wey yu go born, naim I go take bless all di family wey dey di world.’


wey bi Israel pipol, go fit asept Christ. Na dem God choose as en own shidren, E make agriment with dem kon give dem en law. Na dem get di temple and wetin God promise.


Dis pipol bi like river wey nor get wota, dem bi like kloud wey breeze dey blow anyhow and na dem God dey keep di place wey dark pass, dey wait.


God nor sorry for di angels wey sin, E trow dem for hell and tie dem for darkness until di day wen E go judge di world.


Dem bi like wave for sea wey dey foam kom out. Dem bi like star wey nor dey stay one place and God don keep di place wey deep pass for darkness, dey wait dem.


Pipol wey dey do like dogs, doz wey dey do majik and kill odas; doz wey dey serve juju and dey like to lie, all of dem nor go enter di town.


E dey wosh and guide di pipol wey E choose, but E dey make wiked pipol shut up for di dark place wey dem dey, bikos nobody fit win war with en own pawa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ