4 How yu won take tell yor broda sey, ‘Make I remove di dirty wey dey yor eye, wen big wood dey yor own?’
As pesin wey en leg cripple nor fit use am, na so too foolish pipol words dey yuzles.
Una wey bi oga wey blind! Una dey remove fly from una drink, but una dey swallow melu!
“Why yu dey si di small dirty wey dey yor broda eye, but yu nor dey si di big wood wey dey for yor own?
Yu wey dey pritend, first remove di big wood wey dey yor eye, den yu go fit si di small dirty for yor broda own.
How yu go take tell yor broda sey, ‘Broda, make I remove di dirty wey dey yor eye, but yu nor dey si di wood wey dey yor own eye? Yu wey dey pritend, make yu first komot di wood for yor eye, den yu go si well to fit remove yor broda own.’