26 But pesin wey hear my word and e nor do am, e bi like foolish man wey build en house on-top san.
Even before dia time end, wota don karry dem go.
Wise woman dey build en house, but foolish woman dey skata en own with en hand.
Shame go katch una wise men, dem go konfuse and God go judge dem, bikos dem don rijet wetin E tok. Na wish kind sense dem tink sey dem get sef?
“Pesin wey hear my word and do wetin I tok, e bi like wise man wey build en house on-top rock.
Wen rain fall, wota kon full di groun, den strong breeze kon blow di house, e nor go fall, bikos dem build am on-top rock.
Wen rain fall, wota kon full di groun, den strong breeze kon blow di house, na wons e go fall skata for groun.”
But di pesin wey hear my word and e nor do am, e bi like man wey build house wey nor get strong foundashon. Wen big wota kom, di house go fall skata.”
Foolish man! Yu wont make I show yu sey faith wey nor get work dey yuzles?
“So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!