Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 7:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 So too, evry good tree go bear good fruit, but bad tree, go bear bad fruit.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 7:17
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E bi like tree wey dem plant near wota; wey dey bear fruit for di korrect time and en leaf nor dey dry. E dey prosper for anytin wey e do.


E sey, instead of sadnes, E go give joy and happiness to doz wey dey mourn for Zion. Instead of sorrow, E go put praiz song for dia mout. Dem go bi like tree wey God plant by ensef. All of dem go do wetin dey rite and dem go praiz God for wetin E don do.


Before dis time, I bi like lamb wey dem won go kill, even doh I nor know anytin. I nor know sey na mi dem dey plan dis kind wiked tin for. Dem bin sey, “Make wi kut di tree naw wey e still dey fresh; make wi kill-am, so dat nobody go remember am again.”


Dem go bi like tree wey dem plant for near river wey en rut spread enter di wota. Dem nor dey fear wen hot weda kom and dia leaf dey always green; dem nor dey borda if rain nor fall and dem dey always bring fruit.


Good tree nor go fit bear bad fruit and bad tree nor go fit bear good fruit.


bikos di fruit wey lite get, dey bring goodness, raitiousness and trut.


Make di work wey Christ do for us and how to please God, full una mind. Den all di glory and praiz go bi God own.


den una life go betta just as Christ wont. For all di good tins wey una dey do, make una dey bear fruit and learn to know God more-more.


Wen dis pipol dey follow una chop di fellowship food wey God don bless, dem bi like shuku-shuku for una body. Dem bi like shepad wey nor dey shame, bikos e kare for only ensef. Dem bi like kloud wey just dey blow, but rain nor dey fall. Dem bi like tree wey nor get fruits and God don rut dem komot from groun.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ