8 Make una nor bi like dem. Una Papa know wetin una nid before una bigin ask am.
So, Oga God, I know sey Yu know wetin I wont. Yu dey hear as I dey kry with pain.
Na dis kind tins pipol wey nor know God dey porshu and una Papa for heaven know sey una nid dem.
Na bikos of all dis tins, pipol wey nor know God dey worry demsef, but una Papa for heaven know sey una nid dem.
Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray.