Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 6:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 But wen una dey pray, make una go inside room, klose di door and pray to una Papa for sekret. And una Papa wey dey si for sekret, go reward una for pipol present.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 6:6
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So e enter inside di room, klose di door kon pray to God.


Pipol wey dey do wetin dey rite, God eye nor dey komot from dia body and en ear dey open to hear wen dem kry for help.


bikos as yu do like dis, yu go make shame katch am and God go reward yu.


My pipol! Make una dey go! Make una enter una house kon lock una door! Make una hide unasef until God don vex finish,


Even before dem go pray to mi, I go ansa dia prayers and as dem still dey tok, I go hear dem.


Afta di pipol don go, Jesus kon klimb go mountin go pray. E stay der go rish evening.


so dat odas nor go know sey una dey fast, but only una Papa wey dey for sekret go know. And una Papa wey dey si for sekret, go reward una.”


So dat una gift, go dey sekret and una Papa wey dey si for sekret, go reward una.”


Netanel ask am, “How yu take know mi.” Jesus ansa, “Before Filip koll yu wen yu dey under di tree, I don si yu.”


Jesus ansa am, “Make yu neva tosh mi, bikos I neva go meet my Papa for heaven. Go meet my brodas, tell dem sey, ‘I dey go heaven go meet my Papa, wey bi yor Papa too; my God, wey bi yor God too.’ ”


Kornelius ansa, “For days ago, for dis kind time for aftanoon, as I dey pray for my house, one man wey en dress dey shine kon stand for my front.


For aftanoon for di next day, as di men dey near di town, Pita kon go di housetop go pray,


But Pita drive all of dem go outside, den e knee down kon pray. E turn face di dead body kon sey, “Tabita, get up!” Naim di woman open en eye and wen e si Pita, e kon sidan.


Bikos pipol wey dey live by dia own mind, dey tink of only demsef. But evribody wey di Holy Spirit dey rule, dey tink of tins wey di Spirit wont.


Bikos of dis, I dey knee down for awa Papa front,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ