Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 6:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 “Anytime wey una dey pray, make una nor do like pipol wey dey pritend, wey like to dey stand pray inside sinagog and for road, so dat pipol go si dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 6:5
34 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

My King and my God, make Yu listin to my kry for help, bikos na only Yu I dey pray to.


For morning, aftanoon and nite, I dey kry with pain and God hear my vois.


God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.


God hate pipol wey dey karry body up; E nor go let dem eskape en ponishment.


Wen una raiz una hand dey pray, I nor go look una. Even if una pray many prayers, I nor go listin, bikos blood don stain una hand.


Den una go koll my name kon pray give mi and I go ansa una.


Wen Daniel hear wetin happen, e kon go en house. E klimb go one room for up wey en window face Jerusalem. Just as e dey do before, e knee down for di window wey open kom pray give God and e dey do am three times evriday.


If una bilive, una go get anytin wey una ask for, wen una pray.”


“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.


“All wetin dem dey do, na make pipol for si dem. Dem dey tie tins wey dem rite God word put for dia fore head and hand, so dat pipol go si dem.


Dem like betta place for party and betta chair for inside sinagog.


“Make una nor dey do good bikos una wont make pipol si una; if una do so, God nor go pay una for di good wey una do.


“Wen una dey fast, make una nor skwiz una face like pipol wey dey pritend, so dat pipol go si sey dem dey fast. I tell una true word, dem don already get dia full reward.


“Anytime una give sometin to pipol, make una nor show unasef as pritendas dey do for dia sinagog and road, so dat oda pipol go praiz dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.


So, make una pray make di Oga God wey get di farm, send pipol wey go work for en farm, kom.


Anytime una dey pray, if una get anytin for mind against anybody, make una forgi-am, so dat una Papa wey dey heaven go forgive una too.


Wen Jesus dey tish, e kon sey, “Make una dey kareful about di pipol wey sabi di law. Dem like to waka about with long klot and dem like loud greetin for market,


“Curse dey una head! Una wey bi Farisee pipol! Una dey won sidan for betta chair for sinagog and una dey like make pipol dey greet una for market.


Den Jesus tell dem one parabol to show sey, e good make pipol dey always pray.


“But di tax kollector stand for far place and e nor even look heaven, but kon nak en chest dey sey, ‘God, make yu sorry for mi, bikos I bi sina!’


Dem dey sofa wimen wey dia husband don die and kollect dia tins kon dey pray long prayer make pipol for si dem. So na dia ponishment go big pass.”


“But curse dey una head, una wey get money well-well naw, bikos una don already get una reward.


Before naw, una neva take my name ask for anytin. Naw make una use my name ask for anytin wey una wont and una go get am, so dat una joy go full well-well.


With difren prayers, make una dey ask God to help una. Make una always dey pray with di Spirit and dey shine una eyes well-well. Make una nor give up, but make una kontinue to pray for all God pipol.


But E give us plenty grace. Na dis make God word sey, “God dey against pesin wey dey karry body up, but E dey give grace to pipol wey dey put dia body down.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ