“So I tell una, make una nor worry about una life, wetin una go chop or drink and wetin una go wear for body. Life nor big pass food? Abi body nor betta pass klot?
“Wen dem karry una go sinagog or go meet govnors and pipol wey get pawa to judge una kase, make una nor worry about how una go defend unasef or wetin una go tok,
“I don tell una all dis tins, so dat my peace go stay with una. Wahala full inside di world and sofa dey too, but make una heart dey strong, bikos I don already win di world.”
Dem enkourage di disciples sey make dem get heart and make dem kontinue to dey bilive sey, “Wi go must sofa well-well for pipol hand, before wi go fit enter God Kingdom.”
Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray.