24 “Nobody go fit serve two oga, e go hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en heart and nor respet di oda one. Nobody go fit serve God and money for di same time.
So dem bring all dia animals kon give Josef and Josef give dem food afta dem don drop dia horse, sheep and kattle. E save dem dat year, bikos e still dey give dem food chop wen dem bring dia animals.
Elijah kon tell di pipol, “Na how e go tey rish before una go know wetin una suppose do? If God na di korrect God, den make una follow am! But if na Baal korrect, make una follow am too!” But di pipol nor tok anytin.
God wey get pawa sey, “Israel pipol, make una dey do wetin una like! Make una kontinue to serve una juju! But I dey warn una sey, afta una don serve juju finish, una go must obey mi kon stop to rijet my name wey dey holy, bikos una dey ofrin to juju.
“No savant go fit serve two oga, bikos e must hate one kon love di oda one, or e go serve one with all en body dan di oda one. So, yu nor go fit serve God and money for di same time.”
So I tell una true word, make una use una money well, so dat una go make friends for unasef and wen di money finish, God go welkom una for en kingdom wey go dey forever.
Una tink sey, I dey try to do tins make pipol for like mi? Abi I dey do wetin God wont? Or I dey try to make belle sweet pipol? If I dey try to make belle sweet pipol, den I nor bi Christ savant again!
Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.
Una wey dey do bad tins for dis world, una nor know sey to bi dis world friend, mean sey una bi God enemy? So anybody wey gri sey en and dis world na friend, don make ensef God enemy.
If una sey una nor won woship God, den today-today, make una choose who una go woship, weda na una grand-grand papa gods wey dey di oda side for di river, or Amor pipol gods wey dey di land wey una dey stay so. But for mi and my whole house, na di Oga awa God wi go woship and serve till wi die!”
Samuel kon tell Israel pipol, “If una don really turn from sin kom meet God with all una heart, make una remove all di small-small Ashtoret gods wey una get. Make una give una heart to God kon serve only en. Den E go save una from Filistia pipol pawa.”