Una own don finish! Una wey dey sey bad tins, good and good tins, bad or sey darkness na lite and lite na darkness. Una dey sey bitter tins sweet and sweet tins bitter.
Una wey bi savants, make una obey una mastas (dey do wetin dem tok) for evritin and nor bi only wen dem dey look una. Make una nor dey do like pipol wey wont make dem praiz dem, but make una dey obey with betta mind, bikos una dey fear God.