Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 6:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 “Wen una dey fast, make una nor skwiz una face like pipol wey dey pritend, so dat pipol go si sey dem dey fast. I tell una true word, dem don already get dia full reward.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 6:16
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

David pray to God make di pikin well. E nor gri chop anytin and evry nite, e go enter en room liedan for groun.


En ofisas tell am, “Wi nor undastand dis tin! Wen di pikin dey live, yu kry for am and yu nor gri chop, but as e just die, yu get up go chop!”


Wen Elijah tok finish, King Ahab tear en klot kon wear sak klot. E nor gri chop; e sleep with di sak klot and e kon dey sorry for ensef.


Wen I hear all dis tins, I sidan kry well-well and I nor chop for many days. Den I pray to God sey,


“Go gada all Jew pipol for Shushan, den make una fast and pray for mi. Make una nor chop or drink anytin for three days and nites. Mi and my savants go do di same tin. Afta di fasting, I go-go meet di king, even doh dat kind tin dey against di law. If na dat one go make mi die, den make I die.”


Bikos I dey fast since, my legs don weak and my body don turn to ordinary skin and bone.


Wen dem dey sick, I dey sorry for dem. I dey ponish mysef as I dey fast for dem. If I dey lie, make God nor ansa my prayers!


I dey kry and I nor gri chop food and na dis make odas dey curse mi.


So I wear sak klot, sidan for ashes den turn to God kon dey beg am as I dey pray and fast.


Una sey, ‘E nor get wetin pesin go gain if e serve God. Wetin bi di nid to do wetin E tok or try to show Oga God sey wi dey sorry for wetin wi do?’


“Make una nor dey do good bikos una wont make pipol si una; if una do so, God nor go pay una for di good wey una do.


“Anytime una give sometin to pipol, make una nor show unasef as pritendas dey do for dia sinagog and road, so dat oda pipol go praiz dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.


“Anytime wey una dey pray, make una nor do like pipol wey dey pritend, wey like to dey stand pray inside sinagog and for road, so dat pipol go si dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.


Naw, John di Baptist disciples and di Farisee pipol dey fast. So dem kom meet Jesus sey, “Why John disciples and di Farisee pipol dey fast, but yor disciples nor dey fast?”


I dey fast two times a week and I dey pay one out of evry ten tins wey I get, give yu.’


E don rish eighty-four years since en husband die. E nor dey komot for di temple, e dey serve God and dey fast and pray day and nite.


Kornelius ansa, “For days ago, for dis kind time for aftanoon, as I dey pray for my house, one man wey en dress dey shine kon stand for my front.


Wen dem don choose eldas wey go lead di bilivers for di difren-difren church, dem kon pray and fast sey, make God protet dem.


Make una nor refuse each oda, escept una gri sey una go dey like dat for sometaim, so dat una go fit pray. Den Satan nor go fit tempt una, bikos una go fit kontrol una body.


I don do hard work; nor sleep for many nites; food and wota go dey hongry mi; many times, I nor get food to chop. I don dey for kold and I nor get klot to kover body.


for di time wey dem dey beat us and put us for prison; for di time wey dem dey fight; for wahala time; for nite wey wi nor fit sleep and for hongry time.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ