David go meet dem kon sey, “If una kom like friends kon help mi, den I go make agriment with una! But if una kom sell mi give my enemies wen I nor tosh or wound una, make awa grand-grand papa God si evritin kon judge una.”
But make una love una enemies kon do good and make una nor espect anytin back wen una borrow anybody sometin. Na dis go make God pay una back and una go bi en shidren, bikos God ensef dey do good for wiked pipol and doz wey nor dey sey tank yu.
Di next day, Moses si two Israel men dey fight and e won try setol dem. So e tell dem, ‘My pipol, una bi brodas, why una kon dey fight unasef like dis?’
Finally my brodas and sistas, make una use happiness dey do tins as dem suppose bi. Make una take heart, dey greet each oda and live togeda for peace and di God wey get love and peace, go dey with una.
Make una dey bear with each oda; dey forgive each oda; even doh una get wahala with anybody. Just as Christ don forgive una, make una forgive odas too.