Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Matiu 5:48 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

48 So make una dey pafet as una Papa wey dey for heaven, pafet.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Matiu 5:48
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen Abram na ninty-nine years, God appear to am kon sey, “Na mi bi di Oga God wey get pawa. Follow mi waka and nor-tin go do yu.


Di tins wey dis God dey do, dey pafet. Make wi trust en words! E dey kover pipol wey wont make E protet dem.


So, make yu follow doz wey dey honest and dey do good, bikos doz wey like peace go get betta future.


I bi di Oga una God and una go make unasef pure kon dey holy, bikos I dey holy. Una must nor dirty unasef.


“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Una must dey holy, bikos mi wey bi Oga una God, dey holy.


Una must dey holy to mi, bikos mi wey bi God dey holy and I don separate una as my own.


Like dat too, make yor lite shine well-well for where pipol dey, so dat dem go si di good tins wey yu dey do, wey go make dem praiz yor Papa wey dey heaven.”


so dat una go bi like una Papa for heaven wey dey allow sun to shine and rain to fall on-top bad and good pipol.


If una dey greet only una brodas, una nor betta pass odas, bikos pipol wey nor know God still dey do like dat, abi nor bi so?


So, make una dey show mesi, just as una Papa dey show mesi.”


No student go fit big pass en tisha, but wen e don learn finish, e go bi like en tisha.


Finally my brodas and sistas, make una use happiness dey do tins as dem suppose bi. Make una take heart, dey greet each oda and live togeda for peace and di God wey get love and peace, go dey with una.


Belle dey sweet us wen ever wi dey weak and una dey strong. And na wetin wi dey pray for bi dis, “Una go get evritin wey una suppose get.”


So, as God don promise us all dis tins, make wi wosh awasef komot from evritin wey go fit make awa body or awa soul dirty, so dat wi go dey holy as wi dey respet God.


Bikos of dis, mi Paul wey bi prisona for Christ, bikos of una wey bi Gentile pipol, dey pray give God.


But make una serve di Oga una God well-well, so dat E nor go si any fault for una body.


So una must obey di Oga una God as una dey keep all dis kommand and laws wey I dey give una today.”


As wi dey tell evribody wetin dem go do, wi dey prish Christ and tish with wisdom, so dat wen wi go show una to Christ, una go don dey pafet.


Epafras, wey bi one among una and Christ savant, dey greet una. E dey pray well-well for una, so dat una leg go strong for groun and una go grow as una dey learn di tins wey God wont.


And make una let patient do en work, so dat una go dey pafet and komplete, den una go gain evritin.


And evribody wey get dis hope for Christ, dey make ensef pure, just as Jesus dey pure.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ