47 If una dey greet only una brodas, una nor betta pass odas, bikos pipol wey nor know God still dey do like dat, abi nor bi so?
Any house wey una enter, make una greet di pipol wey dey inside.
I tell yu di trut, if di good wey yu do, nor betta pass wetin di Farisee and di pipol wey dey tish di Law do, yu nor go fit enter God Kingdom.”
If una love only di pipol wey love una, wetin una go gain? Na so bad pipol dey do too, abi nor bi so?
So make una dey pafet as una Papa wey dey for heaven, pafet.”
“If una love only di pipol wey love una, wetin go make God bless una? Even sinnas sef love doz wey love dem.
Awa friend Demas and Luke, wey wi love well-well, wey bi doctor, dey greet una too.
Make una tell di brodas and sistas wey dey Laodicea, with Nimfa and di pipol wey dey gada for en house sey, I greet dem.
But why pipol go praiz yu wen dem ponish yu bikos of wetin yu do and yu bear-am? But if yu sofa bikos yu do good, God go favor yu,