43 “Una hear sey, ‘Make una love una neighbour and hate una enemy.’
So Oga God, make Yu sorry for mi. Make I well again, so dat I go pay dem back!
Make una nor revensh anybody or kontinue to dey hate di pesin, but make una love una neighbour as una love unasef. Na mi bi God.
respet yor papa and mama and make yu love yor neighbour as yu love yorsef.”
“Yu hear as God tell awa papa dem before-before sey, ‘Nor kill and anybody wey kill, God go judge am.’
“Yu hear wey pipol sey, ‘Make yu nor sleep with who yu nor marry.’
Make no Ammon or Moab pesin enter God present; even to dia tent generashon, make nor of dem enter where God dey.
As long as una dey dis life, make una nor ever pray for peace or betta tin for dem.
Make una nor ever forget wetin Amalek pipol do una wen una just dey kom out from Egypt.
But if una do wetin dem rite for God word, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef,” una don do good bi dat.
God don kommand us sey: “If anybody love mi, make e love en broda and sista for Christ too.”