39 But I tell una, make una nor fight, if anybody slap yor face, turn di oda side gi-am too.
Den Profet Zedekaya wey bi Kenaana pikin, waka kom meet and slap Mikaya, den e ask am, “Since wen God Spirit leave mi kon dey tok to yu?”
Pipol dey curse and laf mi. Dem dey slap mi for face and dem don gada against mi.
Nor do bad to pesin wey do yu bad, but make yu trust God and E go save yu.
Nor boast sey, “I go do am back wetin e do mi. Yes! I go deal with am well-well.”
I dey open my back to pipol wey dey beat mi. I nor dey stop dem wen dem dey curse mi; even wen dem dey pul di hair wey dey my face komot.
Pesin wey dem slap for one side, make e turn di oda side. Make e nor tok wen en enemies dey curse am.
Make una nor revensh anybody or kontinue to dey hate di pesin, but make una love una neighbour as una love unasef. Na mi bi God.
Jerusalem pipol, make una gada unasef like sojas, bikos enemies dey hide won kon attack una. Dem go use rod take nak Israel leaders face.
If anybody drag yor shirt with yu, make yu gi-am yor koat join.
Dem tie en eye kon dey ask am, “Oya profesai! Na who nak yu so?”
Di law tishas and di Farisee pipol dey look Jesus with korna eye weda e go heal pipol for Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go take akuiz am.
Den Jesus sey, “If wetin I tok nor korrect, make yu tell mi, but if e korrect, why yu slap mi?”
Wen una take unasef go kourt, dat mean sey all of una don luz.
Make una dey sure sey nobody pay bad for bad, but for evritime, make una always dey do good for each oda and for evribody.
As una dey struggol make una nor for sin, una struggol neva rish to kill una as Christ die.
Yu don kondemn and kill pipol wey nor do bad, bikos dem nor fit stop yu.
Make una nor take bad pay di bad wey pesin do una, instead, make una bless odas, bikos God koll una to bless pipol.