But wen my savant tok wetin go happen; wen I send my messenjas go tell una wetin I plan, I dey make doz plans, happen. I tell Jerusalem sey pipol go stay for der again and dem go ribuild Judah town. Even doh dem skata am before, I go raiz am up again.
So make una look heaven and eart! Di heavens go vanish like smoke, di eart go tear like old klot and all en pipol go die like fly. But wen I diliver am, e go last forever. My viktory, na di final one.
Anytime dem sofa una for one town bikos of mi, make una run go anoda town. I tell una true word, una nor go run pass all di town for Israel, before Man Pikin go kom back.
I tell una true word, among all di pipol wey woman born, e nor get anybody wey big rish John di Baptist. But di pesin wey small pass for God Kingdom, big pass am.
Jesus ansa dem, “Na bikos una faith too small and I tell una true word, ‘If una get faith wey small like mustard seed, una go tell dis mountin, “Make yu move from here go yonda” and e go move and nor-tin go hard una to do.’
“I tell una true word, anytin wey una take prayer tie for eart, God go tie am for heaven and anytin wey una take prayer luz for eart, God go luz am for heaven.
Jesus ansa am, “I tell yu true word, for dat time wen evritin go dey new, Man Pikin go sidan for en throne wey get glory and una wey dey follow mi, go sidan for twelf thrones, dey judge di twelf tribes wey dey Israel.
Jesus ansa dem, “I tell una true word, if una get faith and una nor dey doubt, una nor go only do wetin happen to dis fig tree, but if una tell dis mountin, ‘Make yu move go inside di sea, e go-go.’
“Wish of di two shidren do wetin dia papa wont?” Dem ansa, “Na di first one.” Jesus kon tell dem, “I tell una true word, tax kollectors and ashawo dem go first una enter God Kingdom!
Jesus kon tell dem, “Una dey si all dis tins? I tell una true word, wen di time rish, one block nor go dey on-top anoda one, bikos di building go skata finish!”
“Wen una dey fast, make una nor skwiz una face like pipol wey dey pritend, so dat pipol go si sey dem dey fast. I tell una true word, dem don already get dia full reward.
“Anytime una give sometin to pipol, make una nor show unasef as pritendas dey do for dia sinagog and road, so dat oda pipol go praiz dem. I tell una true word, dem don already get dia reward.
Wen Jesus hear wetin e tok, e sopraiz, den e tell di pipol wey dey follow am, “I tell una true word, I neva si anybody wey get dis kind faith for Israel!
I tell una true word, if anybody tell dis mountin, ‘Komot from here go enter di sea’ and di pesin nor get doubol mind, but bilive sey wetin e tok go happen, God go do am for am.
If dem nor welkom una or listin to wetin una dey tok for any place, make una shake di san komot from una leg as una dey leave der, to show sey dem rijet di message.”
Make una look, una shidren don skata! And I tell una true word, una nor go si mi again until una go sey, ‘God don bless di pesin wey kom with en name!’ ”
Jesus ansa am, “Yu really ready to die for mi? Make I tell yu true word, before fawol go do ‘Kukuruku’ dis nite, yu go tok three times sey, yu nor know mi.”
I tell una true word, di pesin wey bilive mi, go do di kind mirakle wey I dey do and e go even do di ones wey big pass dem, bikos I dey go meet my Papa.
I tell yu true word, wen yu dey small, yu dey do as yu like, dey dress as yu like and dey go anywhere wey yu wont, but wen yu go old, yu go spread yor hand and oda pipol go help yu tie yor klot and karry yu go where yu nor won go.”
Naim Jesus ansa dem, “Make I tell una true word, di Pikin nor fit do anytin with en own mind, escept di tins wey e si en Papa dey do. And na anytin wey e si en Papa dey do, naim e dey do too.
Den Jesus tell dem, “Make I tell una true word, nor bi Moses give una bread from heaven, but God, wey bi my Papa, na-im give una di true bread from heaven.